Nollywood actress Nkechi Blessing has lashed out at Anita Joseph’s ex-husband, MC Fish and his girlfriend, Gbemso.
In a series of social media posts, she admonished him to beg for help online so hunger wouldn’t kill him and his girlfriend, whom she described as dirty.
She urged him to open his tag, as she isn’t one to cut corners to call anybody out. NBS further urged him to look at himself in the mirror and see how spoilt his life is.
“As you don off tag. Me and you go really go that route. You kuku sabi me I no dey hear anything. Better beg well so you fit see food chop, cus hunger don almost wan finish you and your dirty gf. Ogun kill two of Una. I wan even ignore Una before!! Dirty couples, una dirty pictures and videos dey smell reach here.
MC Fish, abeg try open your tags, cus me no dey cut through corners to call anybody’s name. If you get mirror for house ni, you see say your life don really spoil. You look hungry, bro, so try open find me so well-meaning Nigerians can contribute for you to feed before you kpai. You this bonga fish, you must be very stupīd!!
If no be NDA I sign before I enter that ring, I get the best reply for you and your dirty GF, but if dem born you and her well, make Una two pick location. Dem go pack Una teeth for ground, dirty set of people. Na me you wan use learn how to talk? E no go better for you join your dirty gf. Oil and gas Almajiri!!
Shameless man, moving from one woman’s house to another, woman wrapper. I go send you go back home!! Lazy thief. Bonga fish!
Na Anita make we dey give you small respect before, but now you no get level!!
No be you say your dirty gf get money pass Anita? So what changed? All of a sudden, you dey form you no want love fake life, Baba come out beg well with your full chest, then drop account make we help your broke sef.


